[Intro]
Ọmọ both fear and faith dey ask you to believe in wetin you no dey see
Na you go choose
[Verse 1]
I go cut my coat oversize this year
I no waka reach here just to waka reach here
And if the tables no turn me I go change chair
Wetin dem go talk, I don't care
God dey my side, I no fear
[Chorus]
I go waka with akonuche
Pass Ebuka, I stubborn (Stubborn, stubborn, stubborn)
Leave shame for back like bumbum
From Abuja to London
This year dem go know say I don come
[Verse 2]
Smart work, no be agidi (Gidi)
Las Vegas, no be Lasgidi (Lasgidi)
This song sharp ko dizzy (Dizzy)
If na useless waka, mó busy (Mó Busy)
I don wicked now, ṣo ti ri n si? (Ṣo ri n si?)
Peoplе bad, na the reason (Reason)
Sincе 2015 I've been singing (Agba singing)
You sef try if e easy (Easy)
E go xup like dream when you sleep, I swear to God almighty
Popsi go show in a brand new truck with my mummy in a GAC
Before I find wetin I see, my mouth no fit talk wetin I see
From this year talk to me nicely
[?] supremacy
[Chorus]
Go ask Ebuka, I stubborn
Leave shame for back like bumbum
From Abuja to London
This year dem go know say I don come
Pass Ebuka, I stubborn (Stubborn, stubborn, stubborn)
Leave shame put for back like bumbum
From Lagidi to London, eehn
This year dem go know say we don come