FELA KUTI


Mr. Grammarticalogylisationalism Is The Boss Lyrics

Now listen to me now
My brothers and sisters
I beg you now listen to me now
Oh now listen to me now
My brothers and sisters
I beg you now listen to me now

They na be man
(Which man?)
Wey talk oyinbo well well to rule our land o
(That man!)

Oh yes

[Chorus]
Him talk oyinbo pass English man!

Him talk oyinbo pass America man
Him talk oyinbo pass French man
Me I say him talk oyinbo pass Germany man

The better oyinbo you talk
The more bread you go get
School start na grade four bread
B.A. na grade three bread
M.A. na grade two bread
Ph.D na grade one bread
The better oyinbo you talk
The more bread you go get

They na be man
(Which man?)
Wey talk oyinbo well well to rule our land o
(That man!)

[Chorus]
Him talk oyinbo pass English man!

Oh yes
Him talk oyinbo pass America man

Hear it!
One more time
First thing for early morning
Na newspaper dem give us read
First thing for early morning
Na newspaper dem give us read
The oyinbo wey dey inside
Petty trader no fit to know
The oyinbo wey dey inside
Market woman no fit to read
The oyinbo wey dey inside
Na riddle for laborer man

Inside the paper
Lambastical dey
Inside the paper
Ipso facto, dey that one na Latin
Inside the paper
Jargonism dey
Inside the paper
Youth delinquency dey

Who be deliquent?
Na dem be deliquent
Who be delinquent?
The oyinbo talker delinquent
Who be delinquent?
It no be me o

They na be man
(Which man?)
Wey talk oyinbo well well to rule our land o
(That man!)

Oh yes

[Chorus]
Him talk oyinbo pass English man!

Him talk oyinbo pass America man

[Fela makes up some gibberish oyinbo]

Him talk oyinbo pass Germany man
Me I say him talk oyinbo pass French man

Watch Fela Kuti Mr Grammarticalogylisationalism Is The Boss video
Hottest Lyrics with Videos
350351da32c07cd84448f07bfcd37692

check amazon for Mr. Grammarticalogylisationalism Is The Boss mp3 download
these lyrics are submitted by kaan
Songwriter(s): fela kuti
Record Label(s): 2009 Fela Anikulapo Kuti Estate Kft
Official lyrics by

Rate Mr. Grammarticalogylisationalism Is The Boss by Fela Kuti (current rating: 7.15)
12345678910
Meaning to "Mr. Grammarticalogylisationalism Is The Boss" song lyrics
captcha
Characters count : / 50
Latest Posts