FELA KUTI


Power Show Lyrics

I open my eye I see for my land
*(CHORUS) NA WRONG SHOW O
Everywhere you go
Everywhere you dey
Everybody want do power show

Na wrong show O

You reach boarder immigration
officer dey
Him go bluff you
Waste your time
Change him pants
Some dey comb dem hair
Den tidy dem table
Den dem pull dem chair
Before him go know say you dey there
If you no talk quick
Him go go for shit
Him go shit come-back
And you talk to am
Then you suprise when him
Shack for you
Him go say you no go cross
You no go cross today
Na that time dem go start Dem
Power Show O O

Na wrong show

Go post office na the same
Dem go bluff you
Waste your time
Run you up
And then run you down
Dem go tire your body
And then tire your mind
And them tire your whole mind
Dem go say no change for fifty Kobo
Na that time dem go start them
Power Show O O

Na wrong show O

Motor car owner sef him go take
him car push him car push laborer
Down for road
Then him start to yab
Foolish labourer
Nonentity, him no get money
Look him sandals e don tear finish
Look him trouser e don tear for yansh
Look him singlet e don dirty finish
Look him body e no bath this morning
Look him pocket e don dry finish
You go suffer for nothing
You go suffer for nothing
You no know me sha?
I be General for Army Office I
I be Officer for Police Station
I be secretary for government office
You foolish laborer, Nonentity,
you go suffer for nothing
Na that time dem go start dem
Power Show

Na wrong show O

Power Show
Na sad thing
Na bad thing
Na wrong show O
Power na to help your land
Na to help your mates
Na wrong show O

Watch Fela Kuti Power Show video
Hottest Lyrics with Videos
b6f32a804d36d9ffc01b3010fc2d3b35

check amazon for Power Show mp3 download
these lyrics are submitted by kaan
Record Label(s): 2009 Fela Anikulapo Kuti Estate Kft
Official lyrics by

Rate Power Show by Fela Kuti (current rating: 8.50)
12345678910
Meaning to "Power Show" song lyrics
captcha
Characters count : / 50
Latest Posts